Entertainment

I For Don Be Teacher If I No Be Musician – Tems

todayNovember 26, 2025 36

Background
share close

Nigerian singer, Temilade Openiyi, wey people sabi as Tems, don yarn di kind work wey she for dey do if she no dey music industry. For one interactive session with fans for X on Tuesday, Tems talk say if music no work, she for don be accountant or mathematics teacher. One fan ask, “If music no work, wetin you think say you for dey do today?” Tems reply, “I fit don be accountant or mathematics teacher. ”Di multiple Grammy-winning singer don yarn before say she comot her work as digital marketer for January 2018 make she fit focus well on her music career. She release her debut single ‘Mr Rabel’ for July 2018 wey small people dey notice for Nigeria. But she blow big after she feature for Wizkid 2020 single ‘Essence’ wey reach number 9 for Billboard Hot 100 chart after dem release di remix version with Justin Bieber.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

Similar posts

Entertainment

Must Read: 2Baba and Annie Break Up Story

By: Kofoworola Olayinka   Sometimes, love fit real, di memories fit sweet, di children fit precious, but somehow, di marriage still fit scatter for ground. Check 2Baba and Annie Idibia tori from start to finish, you go understand wetin we dey yarn for here and why dia breakup pain plenty […]

todayAugust 31, 2026 10


WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds