Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Chairmo of di Independent National Electoral Commission, INEC, Professor Joash Amupitan, say di commission go need continue to work together with Nigerian Air Force to make sure say election for 2027 and future ones dey free, safe and well organized.
Amupitan tuk dis one when Chief of di Air Staff, Air Marshal Sunday Aneke, visit di commission headquarters for Abuja with im delegation.
According to am, di visit na to make di partnership between both institutions stronger as di kontri dey prepare for coming electoral activities.
Written by: Ridwan Agbomeji
INEC Air Force 2027 election Nigerian Air Force election security
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026