By: Kofoworola Olayinka
IPOB don give gorment last warning over sme sme wey dey surround di hearing of Nnamdi Kanu appeal against im conviction.
IPOB Directorate of State, DOS, Head, Mazi Chris Nwaogu, issue di last warning on Monday for video broadcast.
Dis one come after Nnamdi Kanu family don raise alarm say dem dey delay to hear im appeal and ask make court list di matter immediately.
Di family say Kanu don write Chief Justice of Nigeria and Presido of Court of Appeal, asking dem to quickly list and hear im pending cases.
Dem say di request come because of di long delay around proceedings concerning Kanu continued detention, conviction and life sentence.