Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Iran don talk say Strait of Hormuz dey fully open for all commercial ships to pass as ceasefire dey between Israel and Lebanon.
Abbas Araghchi yarn this one for X, say as dem agree ceasefire, ships fit move freely for the remaining time.
Dem also talk say make vessels follow the normal coordinated route wey Ports and Maritime Organisation of Iran don already announce.
Di so called ceasefire wey dem say go last 10 days, still dey uncertain, as e never clear if Hezbollah go agree follow the arrangement.
Written by: Ridwan Agbomeji
Aragchi interview State of Things in the Middle East Strait of Hormuz update
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026