Israeli Army still dey carry out heavy strikes for Lebanon even after US try broker new ceasefire agreement wey suppose calm tension between Israel and Lebanon.
So like dis now, Hezbollah leader, Naim Qassem don reject di ceasefire, call am fake, and say dem go still target northern Israel if Israel no stop di attacks.
Lebanon Health Ministry say since March 2, over 3,526 people don kpai and 10,733 pipo don wound because of di strikes.
Even wit di announcement for Washington, DC, fighting still dey continue fir different areas inside Lebanon.