By: Rilwan Agbomeji
Dr Ibrahim Tahir, don free after im family pay N50 million ransom to di jaguda boys wey carry am for Edo State.
Di wahala start for January 2, 2026, when Tahir and im younger brother dey open gate for dia compound for City Pride Road, Igbira Camp, Auchi, na so jaduga boys carry dem go.
Unfortunately, di jaguda boys kill di younger brother, come drop im bodi for Orley River near di same area on January 5, but Dr Tahir finally release on Wednesday around 8pm afta family members first N20 million, come later pay N30 million.
Di family, friends, NGOs, and well-wishers join hand collect money, and dis case don draw attention to kidnapping wahala and how communities dey support victims for Edo State.