Former President of Nigeria, Goodluck Jonathan, don find himself trap for Guinea Bissau after soldiers announce military take-over on Wednesday. Jonathan no fit comot di country with hundreds of foreign observers wey still stranded. E travel go Bissau ahead of di elections wey dem don conduct but di results never still officially declare. People wey rush go airport after dem hear about di coup dey stuck as movement don lock down.
A day after di two leading candidates, President Umaro Sissoco Embalo and Fernando Dias, both claim say dem win, one group of military officers talk say dem don take “total control” of di country. Di officers, wey call demself di “High Military Command for di Restoration of Order”, suspend di electoral process “until further notice”. Dem still close all land, air and sea borders and put overnight curfew wey don hold everybody for one place.