By: Esther Ayoola
Former manager of music icon, Innocent Idibia wey everybody sabi as 2Baba and pikin of late legend Christy Essien-Igbokwe,, Kaka Igbokwe, don confirmate say di old trending video of 2Baba arrest for London after him quarrel with him pregnant wife, Natasha Osawaru, na true.
Recall, 2Baba travel go United Kingdom with him pregnant wife for concert tour, but him no show for di October 2, 2025 performance wey dem schedule for am.
As 2Baba no show, rumours begin fly say police arrest am after fight burst between am and him new wife, wey still be Edo State House of Assembly lawmaker, Natasha Osawaru, for airport.
But to confirm di mata, Kaka Igbokwe yarn for Daddy Freeze Instagram Live yesterday evening say, everything wey dey fly fly for social media about di couple fight na true.