One police officer for Katsina State don disappear after e sign out im service rifle and vanish soon after e report for duty. According to security analyst Zagazola Makama wey post am for X on Thursday, di officer, PC Ahmed Tukur from Danmusa Division, report for duty on November 23 around 6 p.m. e sign out AK-47 rifle wey get breech number 13492 for standby duty. Shortly after e collect di gun, e waka comot di station and dem never see am again. Efforts wey im colleagues do, including waka go im house and contact im family, never produce any info about where e dey. Police command don intensify effort to find di missing officer and recover di rifle as dem describe di matter as serious security wahala.