By: Esther Ayoola
Minister of Aviation and Aerospace Development, Festus Keyamo, tuk on Tuesday for radio, Ilese-Ijebu, Ogun State, say na one weak link for back of Akure Airport, Ondo State naim allow jaguda boys enter di airport do nonsense.
Di Minister say all airports for di obodo Naija sha get dia safety packages, travellers nor suppose fear, but wetin hapun dat day for Akure airport na di weak link cause am.
Keyamo also admit say FAAN and Ondo State police give different tori about wetin hapun, so e don order proper investigation to know di correct facts.
E explain say di problem for di airport wey dem report na outside security gbege, wey con enter airport, no be say dem come attack airport.