Articles

KONFAM FM DO JOINBODY COLLABO WITH MINISTRY OF HOUSING

todayJuly 7, 2026 9

Background
share close

One ogbonge proverb yarn say, House wey dem no finish, fit become hideout for wahala or Jaguda boys” and na di same message Lagos State Ministry of Housing carry come today as Konfam FM 89.5 pay dem courtesy visit for Alausa, Ikeja.
For di meeting, di permanent secetary of di ministry Engr. Abdulhafis Gbolahan Toriola call on Konfam FM make e join hand with government to educate Lagos residents on housing matters wey concern everybody.

One of di biggest concerns wey dem raise na di plenty abandoned buildings wey scatter across Lagos.
According to Gbolahon, many of those houses no suppose remain ghost buildings. Dem say if owners fit complete di projects, thousands of new homes go join di housing market and more families go get better place to live.

Dem also remind residents say, “one finger no fit pack stone.” So therefore Government alone no fit solve Lagos housing challenge because di population dey increase every day. Na why dem say everybody property owners, developers, landlords, tenants and even di media get role to play.
Di ministry still use di opportunity remind Lagosians say if landlord, tenant or estate agent dey cheat anybody, make dem no keep quiet. Dem fit report di matter to di Lagos State Real Estate Regulatory Authority, LASRERA, wey government set up to handle complaints and regulate real estate activities for di state.

Konfamfm 89.5 on dia part agree to collabo to use dia platform take informate di public on di things wey dem need to know and wetin dem suppose do if dem enter gbege for housing matter.
As Konfam FM and di ministry begin dis partnership, di goal na to make konfam information reach di people because person wey get konfam information no dey enter pit with eye open.

Editor:
Mariagoretti Ulugbe

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds