By: Esther Ayoola
Leader of New Nigeria Peoples Party (NNPP), Rabiu Musa Kwankwaso, don sama beta warning to im members wey dey reason to waka from di party say political betrayal no dey bring long-term success.
E tuk say, as e dey meet supporters for im house for Kano, afta reports say some members, including Kano State Governor Abba Kabir Yusuf, dey plan to comot from party.
Kwankwaso say e no go surprise, if dem nor succeed for dia new party say history don show wetin fit happen to people wey jump, jump political party anyhow.