By: Esther Ayoola
Oga national leader of New Nigeria People’s Party (NNPP), Rabiu Musa Kwankwaso, say im nor be mumu oh, dat im go only waka go another party, if dem agree to give am presidential or vice-presidential ticket for 2027 election.
U sabi say, Peter Obi join African Democratic Congress (ADC) last year and e go dey contest presidential ticket with Atiku Abubakar and Rotimi Amaechi, wey fit cause wahala inside party.
Pipo dey also talk say Kwankwaso fit join ADC, but nobody sure whether Nasir El-Rufai dey reason to contest too.
Addressing tori pip on marras of governance for Kano state, Kwankwaso say, Kano State Govo, Abba Yusuf, plan to waka go APC na betrayal to di Kwankaso movement.