OBODO NAIJA

Kwara Police Commissioner Start Surprise Inspection For Police Divisions

todayAugust 27, 2026 8

Background
share close

By: Mariam Ajayi

Kwara State Police Commissioner, Ojo Adekimi, don start surprise inspection of police division and formation across di state to check officers discipline and work condition.

Di inspection, wey start on Wednesday, cover Area Command, Metro, Ilorin, plus 12 divisional police headquarter inside Ilorin metropolis.

Di State Police Public Relations Officer, Adetoun Ejire-Adeyemi, fry mouth on top dis mata for statement on Thursday.

She tok say di exercise go allow di commissioner personally assess officers professionalism and commitment, identify operation challenges and gap, and understand di hardship wey personnel dey face as dem dey carry out dia work.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds