Lagos

Lagos Assembly Give Order To Stop Makoko Demolitions

todayFebruary 3, 2026 7 12

Background
share close

By: Esther Ayoola

Lagos State Assembly don meet Makoko people wey demolition affect on Monday for Lagos, to address di wahala wey di demolitions dey cause.

Chairmo of House Committee on Makoko Demolition, Majority Leader, Noheem Adams direct say, make all ministries and agencies stop demolition for Makoko, Oko-Afon, and Shogunro, to prevent more community stress.

Adams say, moving forward, lawmakers go waka go di area to check wetin dey happen on ground and confirm di specific setbacks for gornment  before dem go take decision.

Say Community leaders go join Taskforce Committee wey dem go form so dem fit participate and find solution for di problem.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app