Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By: Esther Ayoola
Lagos State Gornment like dis don begin eye testing and other health check for commercial drivers under one programme dem call Drivers’ Care Initiative, to stop askident.
According to Senior Special Assistant to Govo Sanwo-Olu on Transport and Logistics, Hassan Adekoya, say, di move na based on say gornment dey worry about di increase of road crashes for Lagos.
Di exercise hapun for Lekki on Tuesday, where many commercial drivers come out in large numbers to do di medical check and safety training.
Adekoya say dis ogbonge doings also include drivers training, drug and alcohol test, plus serious sensitisation to make sure say drivers stand fit to drive.
Written by: News Author
Lagos drivers vision screening Lagos eye test for drivers Lagos road safety enforcement
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025