Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By: Esther Ayoola
Police for Zone 2 Lagos, don do jaki chan for one man wey dem name Israel Onen for Federal High Court over N60 million visa yahoo wey im do.
Onen face four charges wey include conspiracy, fraud, money laundering, and stealing.
Court hear say between 2024 and 2025, Onen joinbodi with some pipo wey sti dey on di run collect N60 million from one innocent Ayodele Emmanuel.
Police tuk say Onen go leak Ayo ear, pretend say e wan hellep am get Ireland and Schengen visas, an na from dere im an di gang carry di money gbase.
Di sweet tori be say Yahoo Onen dey police custody
Written by: News Author
Internet Fraud Nigeria Lagos Court N60 Million Fraud Case Yahoo Yahoo Fraud
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025