Lagos

Lagos Crowd Beat Man Wey No Too Strong For Body Because Dem Say Im Thief Person Manhood

todaySeptember 22, 2025 4

Background
share close

“One crowd for Agunbiade area for Somolu, Lagos State, don beat one man wey people never sabi, wey no too strong for body, sake of say dem talk say he use juju thief another man manhood.” “Dis thing happen just one week after one NURTW member, Samsideen Oladiti wey dem sabi as Shamelon, allegedly beat one tricyclist die for Lagos Island area for state.” ” One eyewitness wey dem just call Gbenga, say wahala start on Thursday, when one man shout say im manhood don disappear after im carry money for ground wey the disabled man drop.”

“According to am, the alarm gather plenty pipo wey come jam the suspect, beat am, tell am say make e return the victim gbola.” “Dem talk say the suspect confess say na the money im use do di diabolical work and say if dem let am waka go another place, e go restore the manhood.” “Di eyewitness add say police officers from Onipanu Division come later stop the gbege and solve the mata. “Afta dem commot, I hear say di man talk say him manhood don come back and say na di police help dem settle di mata,” he yarn.

 

 

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app