Uncategorized

Lagos First Lady, Ibijoke Gather Boys To Stop Yahoo

todayFebruary 26, 2026 4

Background
share close

Wife of di Lagos State Govo, Ibijoke Sanwo-Olu,  don advice young boys for Lagos make dem comot body from cybercrime, say na bad character bi dat.

She yarn dis one for the Lagos Boy Child Initiative Residential Workshop wey happen for St. Gregory’s College, say boys must use social media for good and no allow peer pressure push dem enter bad tin.

According to her, too much exposure to digital platforms without proper guidance dey make many boys chase quick money and fall into crime.

She come advise say make dem build strong character, get self-discipline, and always choose to do di right thing, say true leadership start with integrity even when pressure dey. Ondo People Enter Streets Over Celestial Church Kidnapping for Uso, Owo LGA

Say nor small gbege for area, as mehn mout Ondo State  gate, block everywhere for Akure, dey protest say kidnappers carry five worshippers from Celestial Church of Christ for Uso, Owo LGA.

According to report, say na six pip di kidnnapers bin carry, but one manage escape, remaining  five for di kidnappers hand.

Di Residents dey vex  wella, so Wednesday dem gather road block, dey sing solidarity songs, dey beg government make security hellep dem.

One protester wey dem call Deoye, even say di security mata dey bad every day, calling on di gorment to do di needful and save pipos from dis badness.

 

 

Written by: Ridwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app