Lagos

Lagos Gornment Close Oshodi Market

todayJune 24, 2026 5

Background
share close

By: Yusuf Abuh

Lagos State Gornment don shut down, close everywia for Oshodi Resettlement Market say some jaguda pipo go attack sanitation enforcement officers during operation.

Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, naim put dis one for statement on Tuesday, say di traders for di market block officers from doing dia work.

According to am, di environmental sanitation officers bin dey carry out operation to arrest street beggars and hoodlums when di attack hapun.

Wahab sti explain, dis Oshodi jaguda pipo scata dia operational vehicles, beat beat dia officers for Oshodi, so like dis di market dey close.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds