Health

Lagos, Hear Word! Stop Short Put, Dat Open Toilet Business AKA, Open Defecation

todayJune 1, 2026 3

Background
share close

Di ancient elders talk say di person wey dey kahkah for road fit forget, but di person wey step on am go always remember.

Today wetin we dey see na men, women and childresis dey spoil Lagos gutters and beaches with hot kahkah wey oyinbo dey call open defecation, say e don become heavy weight wey dey spoil our city face and threaten everybody health.

 

When people drop heavy mata for public, rain go wash di dirty enter our underground water and lagoon, meaning say di same “water wey we use wash fish” go still end up inside our own belle as sickness.

 

Cholera, typhoid, and diarrhea no dey just happen out of nowhere, na dirty dey cause am and if we no dey careful,  e go catch us and land our pikins dem for hospital because of di germs wey dey fly from dis open toilet business.

 

Poverty no be excuse to wear dirty cloth go palace, always obey government law and use public toilet to avoid open toilet business, for government and communities, dem gat build and maintain public toilets, while everybody must join hand to stop di jagajaga for area based on say, if one finger touch oil, e go surely touch di four finger wey remain.

 

Di goat wey get ear na him dey save him head when hunter enter bush, so make we stop open defecation today and use proper toilet to make Lagos clean, wealthy, and truly be di pride of Africa.

 

– Esther Ayoola

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds