Lagos

Lagos Police Kramp Two Traffic Robbers

todayDecember 10, 2025 11

Background
share close

By: Esther Ayoola

Unto securioty doings, like dis, lagos police comand  don kramp two suspected traffic robbers for same place wia one woman blow alarm say gang dey wori pipo for ojota-ketu road, just one day ago.

Di women, bin package message send directly to di Lagos Police Public Relations Officer, via X, SP Abimbola Adebisi, She yarn say four boys rush her car for ojota bridge for broad daylight, korokoro when she dey waka with her pikin.

Di gbege no be small say dem even hammer her side window with stones and beta blow b4 dem enter her car.

Reacting to di report, SP Adebisi confamate dat officers from di Command Intelligence and Tactical Unit immediately ginger boys start operation  response to di distress message.

Di Police yarn say dem never finish, dem dey hunt di remaining guys make road normal again for commuters.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app