Lagos State Police don rescue four pikin wey kidnappers carry, and don return dem back give dia families after one patrol operation wey happen for Alafia Bus Terminal, Coker-Orile for Lagos.
Dis one dey for inside statement wey Lagos State Police Public Relations Officer, SP Abimbola Adebisi, release on Sunday, say on 8th of May, 2026, around 11:40pm, as police officers dey do routine patrol around Alafia Bus Terminal, Coker-Orile, dem see four pikin for one unknown woman hand, as she wan enter one fine bus wey dey travel comot for Lagos State.
So as di woman sight police patrol team, she abandon di childrenses, run enter unknown destination.
Police still talk say dem don start serious search for one suspect wey escape as officers dey carry out di operation.
Lagos State Commissioner of Police, CP Tijani Fatai, praise di officers wey handle di operation for dia quick response and professional way dem take do dia work.