By: Yusuf Abuh
Report wey dey reach our left ear say, some pipo wey get coconut head sti dey throway dirty for Agege railway corridor, Lagos, and dat na so di place dey smell, even after gorment warning.
Dis na according one local official Oyeniran Prince, say, na so pipo park park dirty for di place for almost two years.
Residents dey worry say di dirty environment fit cause disease and pollution, and dat fit scata di railway last last.
Say na railway workers dey come clear di waste all di time as dem ma dey call on relevant authority to pick up dis mata.