By: Rilwan Agbomeji
Two pipo don dkpeme like dis and two others wunjure for ground inside motor askident along Adekunle corridor, very close to Iyana Oworo, Lagos State.
Dis wahala hapun when one Suzuki transport bus comot go jam one pickup van.
Lagos State Traffic Management Authority LASTMA toktok, Adebayo Taofiq, naim even konfamate di askident inside statement
According by inofrmat by di LASTMA oga, na dia officers help rescue the injured victims, carry the dead bodies comot, and clear the road.