obodo oyinbo

Landslide Kill Over 200 Small Miners For Rubaya Mine Inside DR Congo

todayFebruary 2, 2026 4

Background
share close

By: Esther Ayoola

For Democratic Republic of Congo, gornment say nor be small tin dey hapun for dia kontri dat, one wicked landslide kpai kpai Miners for one militia base for eastern part of di country wey Armed group  dey control, say na at least 200 pipo dey feared dead.

M23 armed group don capture plenty land for eastern congo since 2021, including Rubaya mine for North Kivu with hellep of Rwanda, for April 2024.

Rubaya mine dey give 15 to 30 percent of world coltan wey dem dey use for phone and laptop.

Say even with di landslide, say Plenty small miners dey dig every day with just shovels and rubber boots dey find wetin nor find dem.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app