By: Esther Ayoola
For Democratic Republic of Congo, gornment say nor be small tin dey hapun for dia kontri dat, one wicked landslide kpai kpai Miners for one militia base for eastern part of di country wey Armed groupĀ dey control, say na at least 200 pipo dey feared dead.
M23 armed group don capture plenty land for eastern congo since 2021, including Rubaya mine for North Kivu with hellep of Rwanda, for April 2024.
Rubaya mine dey give 15 to 30 percent of world coltan wey dem dey use for phone and laptop.
Say even with di landslide, say Plenty small miners dey dig every day with just shovels and rubber boots dey find wetin nor find dem.