Lagos

LASEMA Warn Drivers Afta Two Pipo Kpai For Trucks Askident

todayFebruary 20, 2026 3

Background
share close

By: Esther Ayoola

Lagos State Emergency Management Agency (LASEMA) like dis now, dey vex oh, dey, warn drivers to stop wawawa driving asap, afta two pipo kpai for askident wey hapun Thursday morning for Cele Bus Stop, Apapa-Oshodi Expressway.

Untop yarnings with tori pipo, LASEMA Permanent Secretary, Dr Olufemi Oke-Osanyintolu, say, di  two 40-foot container trucks wey nor get  plate number,  collide, jam di other one wey park on im own.

Oga Olufemi say, na beg im take dey beg driver, make dem take am easy as life nor get duplicate.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app