Lebanon dey celebrate today Friday say, US State Department don announce 10-day ceasefire wey go allow Israel and Lebanon officials sit down negotiate permanent peace and security agreement.
Di US Presido, Donald Trump also tuk say, di deal to end di war with Iran dey very close, and say negotiations fit resume this weekend.
Iran Foreign Ministry, according to Iranian state media, don also konfamate di update, welcoming di ceasefire for Lebanon, and dat e go help ease di tension for di rejoin.
Dem also explain say the truce na part of bigger understanding between US and Iran, hoping say e go bring lasting stability through negotiation instead of war.