By: Rilwan Agbomeji
Liverpool Football Club donĀ share surprise update, dat Aaron Briggs, wey join di club as individual development coach for July 2024, go leave im role with immediate effect.
Di club post for dia official website on Tuesday dat, Briggs dey important part of Arne Slot backroom staff and e help Liverpool win last season Premier League.
Dem norĀ really give full gist on why im dey comot, but dat im work for player development and support behind di scenes make both staff and players appreciate am.
Liverpool give Briggs thank you messageĀ for im contribution and dey wish am better luck for im future.