Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By: Rilwan Agbomeji
For London on Thursday, Mayor Sadiq Khan don warn say artificial intelligence fit cause serious job loss for di city, as e talk say capital dey face era of mass unemployment if care no take.
Khan yarn dis one ahead of speech wey e go deliver later di same day, where e go break down how AI dey affect jobs for UK capital, especially finance, professional services and creative industries.
According to di mayor, because London get plenty office and creative work, di city dey for di sharp edge of dis AI change, wey fit shake job market well-well.
But e still talk say AI get big benefit if dem use am well, as e plan launch review on AI impact and free AI training for millions of Londoners to prepare dem for di future.
Written by: News Editor 1
AI automation job loss London AI impact on employment London London AI job risk London mass unemployment AI Mayor Sadiq Khan warns AI UK jobs threatened by AI
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025