obodo oyinbo

Mali, Burkina Faso Block Americans From Dia Country

todayDecember 31, 2025 7

Background
share close

By: Esther Ayoola

Mali and Burkina Faso don place travel restriction on American citizens after di US put dem for no-entry list.

Both countries’ foreign ministries tuk say di action na “equivalent measures,” as response to President Donald Trump decision to expand US travel ban reach almost 40 countries dis month.

Di US list include Syria, Palestinian Authority passport holders, and some African countries like Niger, Sierra Leone and South Sudan, based only on nationality.

White House explain say dem ban those foreigners because dem believe say some people fit pose threat to Americans.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app