obodo oyinbo

Man Hide Mama Body Inside Freezer for Almost 3 Years, Land Jail

todayAugust 4, 2026 4

Background
share close

By: Esther Daniel

Strange story don shock people as 60-year-old Christopher Phillips collect two years and four months jail term after e hide im mama body inside chest freezer for almost three years.

Court hear say Phillips keep di body of im 89-year-old mother, Sylvia Phillips, for dia family house after she die for March 2023, while e continue to collect her pension and other benefits.

Di man tell court say e no ready to let im mama go because dem two close well well, and e still want spend more time with her.

Police later discover di body during welfare check for di house after her doctor raise concern, and di matter finally come outside.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds