Listeners:
Top listeners:
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Di big men wey dey run Manchester United don believe say di players dey solidly behind head coach Ruben Amorim, based on better tok-tok wey happen between some of di squad and club ogas, na wetin sources yarn give ESPN. Di Red Devils reduce pressure for Amorim head with one 2-0 win against Sunderland for Old Trafford on Saturday. Afta di match, Mason Mount talk say di dressing room dey “100% behind di gaffer” even though di season start shakily. Defender Matthijs de Ligt sef don support Amorim publicly afta dem chop 3-1 loss for Brentford. Sources yarn say CEO Omar Berrada and director of football Jason Wilcox don also yan with key players like captain Bruno Fernandes and di leadership group, and dem sure say support still dey strong for di Portuguese coach.
Dem say di convos no be official type and no be to check whether make dem sack Amorim. But wetin dem gather from di players about di 40-year-old former Sporting CP manager and di mood inside dressing room na correct vibes. Any decision to remove Amorim wey get contract till 2027, go involve Sir Jim Ratcliffe and Joel Glazer, but dem go still collect input from Berrada and Wilcox. Both of dem wey Ratcliffe appoint since e become minority shareholder for February 2024 don dey hands-on to sabi wetin dey sup for club. Dem even get office for Carrington, wey don chop £50 million upgrade so dem dey always link with Amorim and di players. Since dem move back to di main building for Carrington in August, plenty interaction don dey happen between leaders and players. Unlike former CEO Richard Arnold wey dey base for Old Trafford, or even Ed Woodward wey show face steady for Carrington, dis new crew wan sabi everything wey dey go on, make dem no repeat di mistake wey lead to Jose Mourinho sack for 2018 when players no gree back am again.
Written by: News Editor 1
MANCHESTER UNITED TEAM RUBEN AMORIM
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025