National

Manufacturers Block NAFDAC Office, Kick Against Sachet Alcohol Ban

todayFebruary 18, 2026 2

Background
share close

By: Esther Ayoola

Say like dis manufacturers of spirit drink, wey dey under Food, Beverage and Tobacco Senior Staff Association dey protest, say dem nor go gree oh, for NAFDAC office, Oshodi-Apapa expressway, block di gate enter, say make NAFDAC open dia offices.

Dem say NAFDAC seal dia factories because of di ban on sachet alcohol drinks and PET bottles wey small pass 200ml.

Di workers carry placard wey write say “Tinubu no want make jobs loss,” “Stop to dey destroy local manufacturers,” calling “NAFDAC to release dia products Asap.

An as at di time wey wi package dis report on Wednesday, NAFDAC ogas at di top, never sti touchlight di mata

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app