Sports

Maresca Talk Say Palmer Ready To Jam Leeds

todayDecember 2, 2025 4

Background
share close

By: Rilwan Agbomeji

Chelsea Oga, Enzo Maresca don open mouth say Cole Palmer dey fit and ready to jam Leeds United for Elland Road dis Wednesday wey dey come.

Maresca yarn say Palmer dey try gain im full fitness back, but di plan na to push am small-small until e fit run full 90 minutes like before. Di coach add say everybody dey okay, but Romeo still dey recover and Dario wey just start training don slow down again, so dat marras no go worse again pass before.

Chelsea dey unbeaten for six straight games, as dia unbeaten run straight pass ruler, dem dey reason make Leeds no spoil dia shine.

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app