Sports

Messi End Argentina Career With Goal And Two Assists

todayOctober 7, 2026 6

Background
share close

By: Mariam Ajayi

Lionel Messi don end im Argentina international career with one goal and two assists as Argentina beat Benin 3-0 for Buenos Aires on Tuesday night.

Messi set up Nicolás Otamendi for Argentina first goal for 48th minute before e assist Nico Paz for di second goal for 61st minute.

E later score penalty for 71st minute to complete Argentina 3-0 win over Benin.

Di match na Messi final game for Argentina after 21 years of playing for di country, while former Naija coach Gernot Rohr coach Benin for di match.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds