John Obi Mikel tuk one bombshell say Cesc Fàbregas no suppose collect Chelsea manager job, at least for now, say e still too early.
E tuk dis one for im Obi One Podcast, as e praise di work wey Fàbregas dey do for Como but insist say make e gather more experience first.
Instead, Mikel carry hand point Filipe Luís as beta option for di Chelsea job, say na im fit handle.
Even though Filipe Luís never spend too much time for management yet, Mikel believe say im fit know wetin to do for di Stamford Bridge club