Entertainment

Mohbad Widow Wunmi Yab Her Papa-in-law Lawyer Withdraw From Di Case

todayOctober 29, 2025 56 7

Background
share close

Wunmi, di wife of late singer Ilerioluwa Aloba wey everybody sabi as Mohbad, don react to di gist wey talk say her papa-in-law, Joseph Aloba, lawyer don withdraw from di court case wey demand DNA test for her pikin, Liam. Joseph Aloba bin talk say he wan make dem do DNA to confirm whether di small boy wey Mohbad leave behind truly be im son.

For post wey Wunmi drop for her Instagram page dis morning, she talk say di lawyer wey just withdraw from di case na Senior Advocate of Nigeria (SAN). She still yarn say even if her papa-in-law like make he carry all di lawyers for di whole world, e no go fit manipulate di DNA result. According to her, truth no dey hide, and di real result go always show no matter who try to twist am.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

Similar posts

Entertainment

Must Read: 2Baba and Annie Break Up Story

By: Kofoworola Olayinka   Sometimes, love fit real, di memories fit sweet, di children fit precious, but somehow, di marriage still fit scatter for ground. Check 2Baba and Annie Idibia tori from start to finish, you go understand wetin we dey yarn for here and why dia breakup pain plenty […]

todayAugust 31, 2026 10


WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds