By: Esther Ayoola
Oga Presido of Uganda, Yoweri Museveni like dis don dey dust im opponents, dey lead Uganda election result as counting of votes dey on.
According to Electoral Commission of Uganda, afta dem count almost half of di polling units, Museveni get about 76 percent of di vote, while im main challenger, Bobi Wine, get around 20 percent.
Like dis di gbege nor be here, say Bobi Wine party mehn dey complain dat dem don put dia candidate for house arrest based on violence reports from different areas.
Museveni wey don dey rule Uganda since 1986, sti dey believe day na 80 percent im go score,if no wayoo dey inside.