By: Esther Ayoola
Di National Agency for Food and Drug Administration and Control (NAFDAC) don begin enforcement of ban to stop pipo from di production and selling of alcohol inside sachet or small bottle wey less than 200ml.
Inside statement on Thursday, di Director-General NAFDAC, Prof. Mojisola Adeyeye, explain oh, dat, dem no close any alcohol company, dem just wan protect pikin, youths, and young adults from di wahala of Alcohol.
According to her, small sachet alcohol dey cheap, easy to hide, and e dey make am easy for underage drinking, addiction, domestic fight, and road accident plenty.