NAFDAC

7 Results / Page 1 of 1

Background

Health

NAFDAC Say Jigawa Mothers Make Dem Embrace Exclusive Breastfeeding

By Oluwatosin Ibrahim NAFDAC Coordinator for Jigawa State, Mansur Abubakar, on Friday for Dutse urge mothers make dem practise optimal breastfeeding to support babies' survival, growth and development, as Nigeria mark 2026 World Breastfeeding Week. Abubakar say NAFDAC, alongside di Breast Milk Substitutes technical committee, organise radio awareness programme to educate residents on di importance of breastfeeding using major local languages. Di agency also partner with di National Association of […]

todayAugust 7, 2026 10

OBODO NAIJA

NAFDAC Tighten Belt On Alcohol Sachet Ban Over Public Health Wahala

By: Yusuf Abuh NAFDAC don begin fresh movement to close down sachet alcohol products, some pipo im coconut head sti dey sell shecet alcohol. Di agency Director-General, Mojisola Adeyeye, talk dis during press briefing on Tuesday for Lagos, saying di move na to protect children, teenagers and vulnerable people from alcohol abuse. Adeyeye say NAFDAC dey work with health and consumer protection agencies to make sure di ban take full […]

todayJuly 28, 2026 11

OBODO NAIJA

Check Food Label Before You Chop, NAFDAC Advise Nigerians

NAFDAC Director-General, Prof. Mojisola Adeyeye, don tell Nigerians make dem dey read food label before dem buy any packaged food. She tok dis one on Friday for Abuja during di launch of di "Read the Food Label" campaign, say bad food choice dey increase sickness wey no dey spread. According to am, di campaign go help people understand wetin dey inside di food wey dem dey buy and make better […]

todayJune 26, 2026 14

National

NAFDAC Start Di Ban Of Sachet Alcohol To Protect Pikin, Youths

By: Esther Ayoola Di National Agency for Food and Drug Administration and Control (NAFDAC) don begin enforcement of ban to stop pipo from di production and selling of alcohol inside sachet or small bottle wey less than 200ml. Inside statement on Thursday, di Director-General NAFDAC, Prof. Mojisola Adeyeye, explain oh, dat, dem no close any alcohol company, dem just wan protect pikin, youths, and young adults from di wahala of […]

todayJanuary 30, 2026 53 3

Local

NAFDAC Seize Fake Malaria Drugs Worth N1.2 Billion for Lagos Raid

NAFDAC don burst one big warehouse for Ilasa-Oshodi area of Lagos State wey dem discover 277 cartons of fake and unregistered malaria drugs, Malamal Forte wey worth pass N1.2 billion. According to wetin NAFDAC talk, di fake medicine come from one Chinese company wey dem call Shanxi Tianyuan Pharmaceuticals Group, and dem package am enter Naija inside container wey dem falsely label as “spare parts”. Di drugs dey hidden inside […]

todaySeptember 12, 2025 38

Lagos

NAFDAC Burst Fake Malaria Drugs Worth N1.2 Billion For Lagos

As part of the fight to stop fake, adulterated and expired drugs wey full the country, NAFDAC don seize fake malaria drugs wey worth N1.2 billion. As he dey talk to journalists, the Director of Investigation and Enforcement, Martin Dotun, para say even with all the effort wey NAFDAC dey put to clear fake drugs from the country, some bad belle traders still dey import counterfeit drugs come Nigeria, make […]

todaySeptember 12, 2025 39

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds