By: Esther Ayoola
Team Naija don finish dia race for 2026 World Relays for Gaborone, Botswana with ogbonge wins, grabbing two more tickets for 2027 World Championships for Beijing and one for Ultimate Championship for Budapest.
For Day 2 repechage, di mixed 4x400m team, wey get Samson Nathaniel, Mary Kudoro, Chidi Okezie and Patience Okon-George run strong race, finish second with season best time of 3:12.88, behind South Africa.
Di race tight wetin nor good, as both teams dey overtake each other, but Okon-George use her experience hold Germany for back helping Nigeria secure di slot.
For women 4x100m, afta dem mess up baton on Saturday, di girls bounce back for repechage run 42.94s finish second behind France and qualify for Beijing.