Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By: Esther Ayoola
Federal gornment say dem don get ogbonge support of £746 million financing from UK wey go hellep upgrade Naija ports.
Minister of Marine and Blue Economy, Dr. Adegboyega Oyetola, yan dis one for Abuja, say dis money go transform Apapa Port and Tin Can Island Port for Lagos, di main ports wey dey handle more than 70% of Naija trade.
Say di financing agreement, dem go officially sign am, wen President Bola Ahmed Tinubu enter im meetings for London.
UK Export Finance (UKEF) support di deal, wey dem tuk say go make Naija ports fit compete for global market.
Written by: News Author
Apapa Port upgrade Nigeria UK loan Tin Can Island Port modernization United Kingdom Nigeria deal
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026