By: Yusuf Abuh
Nigerian Navy don burst two illegal refinery sites and recover about 85,300 litres of suspected stolen crude oil as dem continue dia fight against crude oil theft for Rivers State.
Navy Director of Information, Captain Abiodun Folorunsho, tok dis one on Thursday, say di operation happen for Ogba-Egbema-Ndoni axis under Operation Delta Sentinel.
According to am, Navy officers discover and scatter di illegal refining sites plus one network wey criminals don reactivate, while dem recover di stolen crude wey dem hide inside dugout pits and reservoirs.
Folorunsho say di operation na part of Navy effort to stop oil theft, protect Nigeria oil facilities and cut off illegal refining activities across di Niger Delta.