Entertainment

Ned Nwoko Talk Say Regina Must Come Back Home Before Dem Free Sammy – Family

todayNovember 5, 2025 64 4 5

Background
share close

Regina Daniels’ elder brother, Sweezy, don raise alarm say dia younger brother, Samuel Daniels wey people sabi as Sammy West, don go missing after police arrest am for Lagos on Monday, November 3, before dem reportedly carry am go Abuja. According to reports, Sweezy drop message for Instagram accuse Senator Ned Nwoko of intimidation, talk say dis one no be ordinary arrest again. E  yarn say Sammy never get lawyer, food or water since dem hold am, and nobody sabi where dem carry am go. E even claim say Ned talk am clear-clear say, “If Regina no come back house, Sammy no go ever comot.”

Meanwhile, Lagos State Police Command don talk say no be dem arrest Sammy West. According to dem, na officers wey come from Abuja with correct warrant arrest am. Dem explain say di arrest happen late for night, na why dem keep am small for Ogombo Police Division, before dem carry am travel out of Lagos for further investigation. Di mata don scatter social media as people dey drag Ned Nwoko for allegedly using power to intimidate Regina Daniels’ family.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

Similar posts

Entertainment

Must Read: 2Baba and Annie Break Up Story

By: Kofoworola Olayinka   Sometimes, love fit real, di memories fit sweet, di children fit precious, but somehow, di marriage still fit scatter for ground. Check 2Baba and Annie Idibia tori from start to finish, you go understand wetin we dey yarn for here and why dia breakup pain plenty […]

todayAugust 31, 2026 10


WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds