Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By Ebi Oboko
Nigeria Football Federation don play down tori say wahala dey for Super Eagles camp for 2025 AFCON for Morocco after small clash happen between Victor Osimhen and Ademola Lookman for pitch.
The incident happen during Nigeria 4–0 win against Mozambique for Fez Stadium, as Osimhen score two goals while Lookman and Akor Adams add one goal each.
Despite the big win, people notice when Osimhen and Lookman get heated argument after one hour for match, and Osimhen later ask coach make dem sub am.
One video wey go viral show Osimhen dey challenge Lookman, as many people believe say na because Lookman no pass ball for clear scoring chance.
Meanwhile, the AFCON round of 16 don conclude beta style on Tuesday with Algeria and Ivory Coast take the last spots for the Quarter finals.
Ivory Coast beat Burkina Faso kondo, while Algeria beat DR Congo 1 kon after Extra time.
Written by: News Editor 1
AFCON latest news Nigeria football breaking news Nigerian football federation Super Eagles players update
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025