By: Kofoworola Olayinka
Niger State Gornment say dem never hear from terrorists wey abduct worshippers during Friday prayers for Borgu LGA on August 21.
Commissioner for Information, Obed Nuhu, disclose dis on Thursday, saying di attack happen for three different locations and suspected Lakurawa and Boko Haram carry am out.
Nuhu say gornment still no know di exact number of people wey dem carry go, because di kidnappers never contact dem.
E add say security agencies dey work to understand di attack and rescue di victims.