Listeners:
Top listeners:
KonfamFM 89.5 We Dey For You
President Bola Tinubu don talk say the bold economic reforms wey him government dey do to bring Nigeria back to better position dey show better results, and e don make people from different parts of di world begin respect Nigeria again. The President talk this one for State House wen him receive Oba Ghandi Afolabi Oladunni Olaoye, Orumogege III, wey be Soun of Ogbomosoland, together with other royal fathers. According to presidential spokesman Bayo Onanuga, Tinubu talk say Nigeria economy don stabilise and e dey attract global attention now. “Years wey Nigeria take dey deceive itself, neglect things, forge records, do smuggling and all those kind things na wetin make the country no fit get the correct money wey e need take move forward and develop,” Tinubu talk. “After that, we come face wahala again wey dey happen from people wey dey do currency arbitrage trading, like say na just to dey sell paper. Corruption full everywhere, and e affect the respect wey people get for the country and our economy well well. But we no fit just siddon look. We gats take action. With una prayers, patience, endurance and better understanding, I dey happy to tell una say today, the economy don stabilize. The bleeding don stop. That serious problem don go the patient don survive.”
President Tinubu also mention some achievements of him government like the establishment of Nigerian Education Loan Fund (NELFUND) wey go make sure say no student go drop out because poverty. E talk say education na the best weapon to fight poverty and their government dey aggressive for infrastructure development, even though na just two years dem don dey in office. Tinubu thank the Soun of Ogbomosoland for the support and credit wey e give the government bold decisions after dem start work. E also say people for Ogbomosoland don dey feel the modernisation and transformation wey the monarch dey bring as e promise to strengthen traditional institutions.
Written by: News Editor 1
BOLA AHMED TINUBU GLOBAL RESPECT LEADERSHIP
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025