Lagos

NIPOST Seize Seven Pouch Of Cannabis For Lagos Consignment Wey Come From Thailand

todaySeptember 18, 2025 5

Background
share close

Nigerian Postal Service (NIPOST) don intercept one consignment wey get seven pouch of cannabis wey dem hide inside duvet cover wey land Lagos from Thailand. One statement wey management drop on Tuesday talk say di shipment come from Bangkok, Thailand, and na one person for Lagos dem address am give. Dem never release di sender and receiver detail as investigation still dey go on by di correct Security Agencies. Dis interception show say we still dey committed to change di postal industry to one secure, reliable, and trusted way for communication and business.

E show NIPOST strong mind to protect di public from di danger wey dey inside illegal substance, and still guard di postal network make e remain clean. Dem don carry di matter give di correct Security Agencies to continue with di next action. As e take match with di Renewed Hope Agenda of di Federal Government, NIPOST don stand gidigba say dem no go ever gree make anybody use dia network for illegal or bad thing. We still stand kampe to protect how our operation suppose be, and we dey assure the public say our commitment no shake at all to make sure say di postal industry continue to be engine for national security, economic growth, and public trust.

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app